Tuesday 21 May 2013

Mourinho don dey pack him bag

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
Jose Mourinho © Action Images




Jose Mourinho go waka comot for Real Madrid wen dis season finish, as hin and de club don siddon, chop knuckle on how dem go finish dis three years of wowo futbal wey Mourinho bin carri come.
Mourinho bin still get three years to stay as Real coachi, onto wetin hin bin gree wit de club bifor, but as hin don dey waka comot Spain now, all de tori wey bin dey ground say hin go waka enta Chelsea, go catch faya now.
Even tho Real neva do naming ceremony for dia new coachi, club presido, Florentino Perez tok say dem don ask PSG if dem fit follow dia coachi, Carlo Ancelotti, discuss.
"As we and our coachi, Jose Mourinho yarn finish, we don gree say e go beta make evribodi ansa hin papa name wen dis season finish," na im Perez yarn amebo dem, for inside Real stadium, afta dia village meeting bin finish.
Na two match remain for dis season to finish and Mourinho las match go be Osasuna nes weekend.
Real for like carri PSG coachi, Carlo Ancelotti, and de guyman don even tok say hin wan comot dia, but de French club neva gree, and Perez tok say no be onli hin dem put eye ontop.
"We neva follow any coachi gree anytin. No be tomoro work be dat. Na work wey we go tink well," na im Perez tok.
PSG oga of futbal, Leonardo, bin yarn ontop French radio on Monday say, notin go hapun as Ancelotti still get one more year to stay wit dem.
"Our gbege now, na to continue dis tin wey we don start so," Leonardo yarn RTL (na radio station for France). "Na wetin wan make us still holo Ancelotti tite."
Mourinho (hinsef don krakpo. He don reach 50 years now) bin waka enta Madrid afta hin helep Inter Milan carri Champions League for 2010. Na onli las year hin and Real bin gree say hin go stay de club reach June 2016.
Wen dem fes hail Mourinho, Real presido, Perez, bin tink say de guyman go fit helep dem win dia numba 10 Champions League cup; sontin wey dem don dey fin since 2002. Den to helep dem kolobi Barcelona, sake of say dose guymen bin don carri Spain league put for pocket.
Na all dat one make Perez gree spend 513 million dollar ontop playa dem, plus de 94 million euro wey dem bin carri buy Cristiano Ronaldo sef.
E don turn June 12 now, bicos na onli one La Liga champion belt and one King's Cup (dia own federation cup) na im Mourinho fit helep dem win wit all dat money.
Mourinho bin helep Real pass las 16 for Champions League (na six years strait Real bin dey try pass las 16) but na semifinal be hin bus stop for de three years he dey Madrid.
"We sef gree say Mourinho carri us go front small and our club sef enjoy hin hand," na im Perez tok.
"E try. Las year we bin dey enjoy de kin futbal Real bin tap, plus all de record wey dem break."
"Dis year sef, de result dem good if na ordinary club get am. Real no be ordinary club."
'E BAD WELL WELL'
De las coachi wey Real gree make he stay reach three years, na Spain national team coachi now, Vicente del Bosque, from 1999 reach 2003. De bros win La Liga for 2001 and 2003 plus ChampionscLeague for 2000 and 2002. Dem still sack am.
Dis season, Mourinho sef don tok say "e bad well, well", Real no fit defend de La Liga wey dem carri las season, and Barcelona no even sweat sef, as dem win dia numba four inside five years.
Real reach Champions League semifinal, but Borussia Dortmund troway dem comot, den Atletico Madrid come waya dem for King's Cup final again.
Mourinho na coachi wey no dey fear to yarn hin mind. but hinsef come carri gbege wey heavy for hin head, as many Real fans dem come dey vex bicos of how hin bin do dia skippo and goalie, Iker Casillas.
Casillas don be Real goalie, e don pass 10 years, and na big eye many Real fans dey carri look am, but Mourinho no gree play de guyman again, since hin bin wound hin hand. Na Diego Lopez, wey Mourinho buy for January, don be Real goalie since dat time.
HE MISS ROAD
Gbege bin don dey Real Madrid dressing room, but de tin come opun, yakata, wen Real defenda, Pepe, tok say hin tanda for Casillas back (even tho hin and Mourinho be de same contri man). Mourinho bench am strait.
De tin bad sotay, wen dem call Mourinho name for stadium, fans dem go dey blow wisu, but if na Casillas name, dem go hail am pieces.
Water come pass garri dis season, wen Mourinho colet red card for King's Cup final, bifor Cristiano Ronaldo follow colet hin own, afta him kick Atletico playa.
"All coachi get how dem be," Perez tok.
"Mourinho bin miss road small and even tho hin tok 'sorry', de gbege bin big pass hin head."
"Mourinho bin yarn me, one time like dat, say futbal for England na two hours bifor match and two hours afta katch finish," na im Perez come follow tok.
"For Spain, futbal no dey finish. Na de whole week plus evri hour. Persin no dey fit sleep sef."

No comments:

Post a Comment